Dis na di opening ceremony for Abeokuta, Ogun State, Nigeria, di National Sports Festival done officially start well.
Village Athleticz Pidgin
Contact information, map and directions, contact form, opening hours, services, ratings, photos, videos and announcements from Village Athleticz Pidgin, Sports Promoter, Asaba.
20/05/2025
Di conference championships wey hapun across di collegiate circuit wit di NJCAA National Championships inclusive last weekend.
Here na di recap of some of di medalists as well for di National Champion for di NJCAA.
20/05/2025
We dey forget one of our own wet compete for di SLC Southland Outdoor Track and Field Championships, Tina Samson wey dey compete for heptathlon event for dis same competition wit new pesinal best of 5,117 score to finish 4th for di comot
19/05/2025
We dey forget one of our own we compete for di SLC Southland Outdoor Track and Field Championships, Tina Samson wey dey compete for heptathlon event for dis same competition wit new pesinal bestv of 5,117 score to finish 4th for di do competition
18/05/2025
My village pipo world wide, Nigeria athletics family, Di Athletics Representative Election wey we all done dey wait for since go take place for di National Sport Festival Games Village for inside Babcock Amphitheatre for Babcock University Ogun State according to the electoral committee tomorrow 19/05/2025 around 8am in di morning.
In case you dey inside di games village as an athlete locate di image wey dey tag join dis post and no forget we go dey dey stream live from our fb page Village Athleticz Pidgin
18/05/2025
Ramat Jimoh get her first ever SEC medal wit Personal Best of 2:03.64 seconds for di 800 metres final.
She finish for 3rd place for bronze medal.
18/05/2025
Ajayi Kanyinsola do wetin hw go fit do but he settle for 2nd place and he con take di silver withl 10.01 seconds for di SEC Championships
Im teammate Israel Okon run 10.07 seconds for 4th place.
18/05/2025
Na only photo finish go fit determine di champion. Even wit di silver, Tima Godbless na our champion!
She settle for 2nd place wit 11.06 na di same time with di winner in of di 100 metres final for di SEC Championship for Kentucky.
18/05/2025
Ella Onojuvwevwo carry silver medal go house for diat SEC Outdoor Championships as he run 51.26 seconds for di 400 metres.
18/05/2025
SAMUEL OGAZI NA SEC CHAMPION!
He done upgrade im 2024 silver to gold, as he win wit commanding time of 45.04 seconds for di 400 metres final.
18/05/2025
1️⃣2️⃣.8️⃣7️⃣ seconds
Adaobi Tabugbo clock her fastest ever race to take win di Big 12 championship for di 100m hurdles: her first legal sub-13 seconds and di 2nd fastest time for di nation for 2025.
Click here to claim your Sponsored Listing.
Location
Category
Telephone
Website
Address
Asaba