13/05/2026
My people Now say Ben White don reportedly miss the rest of the season, the main question before the UCL final na whether Cristhian Mosquera fit handle Khvicha Kvaratskhelia.
Short answer? Yes… but e no go easy at all.
Kvaratskhelia na one of the most dangerous wingers for Europe because nobody sabi wetin him wan do next. Him fit beat defenders for outside, cut enter middle create wahala, create chances from nowhere, and scatter defensive shape completely.
Players like this no dey easy to silence for full 90 minutes. The real aim na to reduce their impact and stop dem from deciding the game.
Mosquera actually get qualities wey fit help am for this kind match. Him strong physically, him quick, aggressive for tackles, and him dey comfortable defending wide areas. Him size and athleticism fit help am deal with Kvaratskhelia especially when PSG wan leave dem one-on-one.
The biggest thing for Mosquera go be discipline. Against winger like Kvaratskhelia, if you rush tackle too early, na danger because na wetin him like pass. Mosquera go need stay calm, delay am, and force am go outside instead of allowing am cut inside towards goal.
Arsenal too no go leave am alone like that. Arteta no dey expose him defenders anyhow especially for big games. Expect support from midfield and right side anytime Kvaratskhelia touch ball. Declan Rice defensive work and Ødegaard pressing fit even become as important as Mosquera own defending.
Physical battle fit matter too. Mosquera get the body and strength to make life hard for Kvaratskhelia. For final, small small details dey decide games, and if Mosquera fit disturb him rhythm early, win key duels, and stop am from building confidence, e fit swing momentum enter Arsenal favour.
No doubt Arsenal go still miss Ben White badly. Him experience, understanding with the backline, and composure against dangerous wingers for pressure moments for don help massively. But finals dey always produce unexpected heroes, and this fit be Mosquera own chance to announce himself to the world.
If Arsenal fit stop PSG from isolating Mosquera too much and defend together as a unit, then yes, him definitely get wetin e takes to limit Kvaratskhelia and help Arsenal fight for the trophy.
Una thoughts?
09/05/2026
My people The Audacity: Charity for London Stadium? 🙄
See delusion for East London don reach another level. Some West Ham fans dey yarn with serious face say make we dash dem 3 points just so dem fit survive relegation battle.
Imagine oo, dem dey enter mention dey beg us make we purposely throw away title race because their “Premier League status” important pass our own historic glory. You get title for your hand, destiny dey call you, but dem want make you “take fall” for club wey no go even reduce price if we wan buy player from dem 😂
Why e funny pass:
Entitlement too much: Dem want make we waste one whole season of sweat, tactics and hard work so dem fit continue another boring mid-table season.
Their logic weak: “Abeg lose your biggest achievement in years so we no go dey play Tuesday nights for Championship grounds.”
Reality be say: We no be charity organisation, na war machine we be.
Dem no really dey find football match, na free gift dem want. Sorry boss, we dey chase trophies, no be participation awards. If una wan survive, survive by una own effort. If not, Championship dey wait. We get league to win 🏆🔥
At this point e just dey feel like everybody suddenly dey pray for Arsenal downfall, or na only West Ham fans dey overdo with this survival strategy? 😂
09/05/2026
Truth be say, plenty Arsenal fans bin want make Bayern Munich qualify, including me sef. We see them as the easier opponent compared to PSG, and e show for the two matches wey dem play.
No doubt, Bayern this season don prove say dem no be small team to play against. But the truth be say this PSG side get plenty special qualities wey no team go pray to face, even if at the end Arsenal go still beat dem for the final.
Right now, PSG dey play one of the sweetest football for world football. Ontop that one, dem get dangerous attackers wey fit wound any team anytime, and dem don show am for the biggest moments this season, just like dem do last season too.
But the sweet part be say, dem never face this stubborn and strong Arsenal side wey hard to break down and solid for back.
Big respect to Kvaratskhelia, Doue, Dembele and Barcola, but Arsenal get their own wall too Saliba, Gabriel, Timber, Calafiori, Hincapie, White and Mosquera. Na warriors be these guys, full of motivation and ready to defend their mission to bring the UCL come home.
May 30th for Budapest, history go happen 🙏
07/05/2026
“Arsenal no fit beat Bayern.” “Arsenal no fit beat Leverkusen.” “Arsenal no fit beat Inter.” “Arsenal no fit beat Sporting.” “Arsenal no fit beat Atletico Madrid.” “No forget say Atletico/Simeone never lose knockout game to any English club.” “Atletico Madrid go qualify for Emirates.” “Arsenal get the easiest road reach final.” “Arsenal no fit beat either Bayern or PSG for final.” “Arsenal no fit win league.” “Arsenal go drop points.” “This na the worst season ever.” “Corner FC.” “Set-piece FC.” “Haram FC.” “Bottlers FC.” “Make we wait till December.” “January.” “February.” “March.” “April.” “City don top table.” “Arsenal don bottle the league.” “Manchester City no go ever drop points again.” “This na the best season ever.” “Manchester City don drop points.” “If Arsenal win league, e go still be the worst season ever.”
Arsenal. Arsenal. Arsenal. Arsenal. Arsenal. Arsenal. Arsenal. Arsenal. Arsenal. Arsenal. Arsenal. Arsenal..
Rival fans .. banter no dey tired Una ?? 😂😂
07/05/2026
The thing be say this PSG team no be like Pep Barcelona wey too mad that time. Dem really dominate their era well well against strong teams like Manchester United, Chelsea and plenty others.
For me, this PSG no dey that same level at all. Na just say many top teams now never really balance.
You go look Real Madrid, you go just know say dem no fit handle PSG. You go see Chelsea, na only hiss remain. Liverpool sef, you just waka pass. Barcelona own self look like team wey PSG fit score 10 goals against across two legs 😂
My point be say PSG dey dominate, but no be because dem too unbeatable like Pep Barca. Na because plenty big teams nowadays just dey underperform.
Last season sef, Aston Villa nearly kpai dem for Villa Park. Arsenal too pressure dem well even though Arsenal lose. Even Maresca Chelsea outplay dem for CWC. You no fit try all those things against Pep Barca that time.
Against Arsenal last season too, make we no forget say players like Gabriel, Eze, Hincapie, Calafiori and Gyokeres no dey available. Kiwior play, Jorginho play, Skelly still inexperienced for left back and Merino dey play striker 😂
For both legs na Donnarumma carry Man of the Match. That one alone suppose tell everybody wetin dey wait for this final.
I no even know whether una dey really understand the point wey I dey try make, but hope una dey catch small small?
06/05/2026
I think say if Mikel Arteta don dey make this kind decision since, Arsenal for don carry EPL trophy already. Yesterday, him choose him first 11 based on performance, no be because say na him favourite players, and e really work well.
Before before, for important matches this season, Arteta for don bench Viktor Gyokeres make Kai Havertz start, bench Eberechi Eze for Martin Ødegaard, and comot Myles Lewis-Skelly give Zubimendi. But yesterday matter different. Him get mind bench all of them and start players wey currently deserve am pass.
If you ask Arsenal fans who be Arteta favourite players, many go mention Kai Havertz, Ødegaard and Zubimendi. But yesterday, Arteta show courage. Him no send name or status, him just start the players wey dey perform better right now.
If Arteta continue dey make this kind fearless decisions, e fit become one of the best managers for world football for long time. One thing wey I always feel say e lack na this boldness, but yesterday, I must confess say e impress me well well. I even check lineup twice because I no believe wetin I dey see 😂
If una remember this season when Eberechi Eze dey hot and dey help us win matches during the time Ødegaard injure, everybody believe say Eze don earn permanent starting spot. But immediately Ødegaard return, straight away dem carry am enter first 11 and Eze come dey warm bench for like 5 matches. I honestly feel say that one cost us.
I just love the bold decision wey Arteta make yesterday. Him make everybody understand say nobody get automatic shirt if you want your number back, you go fight for am 👏
05/05/2026
🚨 Arsenal starting lineup against Atletico Madrid tonight.
ℹ️ Na serious mind Arteta get to still stick with Lewis Skelly. This one no be the Arteta wey we sabi before o 😂
05/05/2026
Antoine Semenyo talk this one after Bournemouth beat us:
🗣️ “Night before Bournemouth jam Arsenal, I yarn some guys say, ‘Abeg do us one favour.’”
Dem no fall him hand at all, dem come beat us 2-1 for Emirates.
Man City still get to play Bournemouth, and I feel say if no be that favour wey Semenyo beg, Bournemouth no go even dey fight for European spot like this.
Now the koko be say, Man City go still meet Bournemouth wey dey 6th, just 1 point above Brentford for 7th. If Aston Villa fit knock out Nottingham Forest on Thursday come reach Europa League final, then 6th position for EPL fit carry Champions League ticket next season. That one go make Bournemouth and Brentford ginger well well to secure that 6th spot.
Europa League final go happen after EPL finish, so I no see Bournemouth doing Semenyo another favour. Dem go dey focus on how to hold that 6th position and dey pray make Aston Villa carry Europa League. Both Bournemouth and Brentford still get match against Man City 😂😂
05/05/2026
🔴 Arsenal fans: No start to dey celebrate yet o. Never reach that side.
Trophy dey near, final fit dey near too, but NOTHING don happen until e happen finish. 💀
West Ham match on Sunday fit be trap game if we go there dey pop champagne already and tonight, Atletico Madrid no send our league position at all. Simeone no dey ever make am easy for anybody for Emirates.
Yes, stats dey our side. Yes, we beat them 4-0 before. But that one don pass. Tonight na fresh 90 minutes one small arrogance fit spoil everything. 🏟️
Arsenal Fans head down, stay locked in. Na business first. 🔒
Drop ♥️ if you dey focused tonight. Let’s go, Gunners! 💪
05/05/2026
Make I drop my own take about our match vs Atletico Madrid before I go drag Man City and other rival fans small 😂😂
I wan see Ben White and Ricardo Calafiori start today for full back, no be say Hincapie no try last time we play Atletico, but I just feel say Calafiori get exactly wetin we need for this kind game.
Atletico go sit back, dey wait catch us for counter attack because Simeone sabi wetin go happen if him open game like last time we deal with them for group stage.
Calafiori sabi how to enter midfield space well well, and that one go help us get more bodies for midfield, use am take control game and wound Atletico. Plus when we dey attack, him dey always join add numbers for front. For game like this, if you plenty for attack, your chance to score go high.
For the other side, Ben White no too strong for 1v1, but him dey okay with ball and him get attacking mind, and na wetin Arsenal need today. We gats attack well if we wan win. Mosquera no really get that attacking quality, even though him good for 1v1. I feel say we fit bring am later when we don dey protect lead.
We go get chance against Atletico if we play with attacking mindset. Our CBs solid, plus make we no forget David Raya wey sabi read game and dey cover any long ball wey pass defense.
Wetin you think?