20/12/2025
🔥 AS E DEY HOT! Thiago Silva don join Fc Porto ontop free transfer, hand don enter paper sign agreement 🤍💙 🐉
Other club been dey rush silva like travelers dey rush gala but him return to Porto don dy sure like bricklayer and cement….. and dem don cement am.
O GIGANTE VOLTOU 🇧🇷
23/09/2025
Ladies and gentlemen your BallonDor winner
Ousamane Dembele!!!!!
05/09/2025
As we enter International break, wey b sey Naija super Eagles 🦅 dey play world cup qualifiers.
Victor Osimhen don comot yarn weting dey em mind to Naija ppl.
E sey as e be so, dem wan play ball nd dem wan qualify nd dem go qualify Insha Allah.
Na d message wey Osimehn geh fr una b dis.
゚viralシfypシ゚
29/08/2025
🔥AS E DEY HOT! Ac Milan don agree deal to sign Christopher Nkuku from chelsea 💙🖤🇳🇱
28/08/2025
🔥AS E DEY HOT! Chelsea don agree to sign Alejandro Garnacho from Man united 💙💣
Dis bobo been only want chelsea and chelsea alone, and as be so e go sign 7 years deal for fee wey dey near €40milla 🤝
Dem don seal dis agreement and dem don join am with 10% sell-on clause.
How una see dis signing, mak una rate am from 1 to 10 ⚡️🇦🇷
26/08/2025
🔥AS E DEY HOT! As e b so now Lucas vázquez don dey ready to join Bayern Leverkusen💣🇪🇸
Dem don agree dis deal with dis bobo wey join as free agent.
Dem don already do medical on Monday, na to sign remain on Tuesday.
Dis na ogbonge signing for Leverkusen🔴⚪️💫
24/08/2025
🔥AS E DEY HOT! Gigio Donnarumma don agree personal terms with Manchester city 💙🇮🇹
Long term deal don dey ready for this Italian goalkeeper and talks don dey road with PSG on how much dis bobo go cost all in all.
❗️dis deal now depend on if Éderson carry all em kaya waka go dis summer.
24/08/2025
🔥AS E DEY HOT! Borussia Dortmund don seal Chukwuemeka deal with chelsea💛🖤🏴
Chukwuemeka join BVB ontop permanent tranfer level wey worth €25milla fee.
Chelsea go also get heavy sell-on clause for Carney.
Make una elp us rate dis signing from 1 to 10.
゚viralシfypシ゚
24/08/2025
🔥AS E DEY HOT! Nottingham forest don agree to sign Douglas Luiz from Juventus 🌳🇧🇷
Fee dey around €30milla for dis bobo wey want move go forest despite other options.
Traveling go take place today if the two clubs do all weting dem suppose do.
Rate dis signing from 1 to 10 ✨
゚viralシfypシ゚
14/08/2025
🔥UPDATE! Bayern don shine coman green light matter to travel go join Al Nasr🇸🇦
Kingsley coman go travel for medical and signing today… every other waka go soon follow
゚viralシfypシ゚
11/08/2025
🔥AS E DEY HOT! Everton don agree deal to sign Jack Grealish on loan from Manchester city💙
The two clubs don follow each other talk and agreement don dey in place sey d loan go last till June….
But dem no include buy option for dis deal.
Grealish accept Everton bcos em wan get more playing time.
DIS BOBO DEY GO GOODISON PARK!🤩