21/08/2026
My brother di way some of una take di push this Okocha tok make me go re-watch di podcast till now I still dey wonder how Okocha take disrespect/downgrade Ronaldo..
Mikel ask Okocha, Messi or Ronaldo, Okocha say Ronaldo na special player and for him, Ronaldo na better goal scorer, e fit score 10 million goals and e fit score from anywhere, Okocha say Ronaldo na goalscorer like Haaland( everybodi know how danger0us Haaland be for front)
But for Messi , Messi dey for anything planet, say dem born Messi to play football according to Okocha.
So tell me how e take disrespect Ronaldo? Shey na because e no call Ronaldo hin greatest player of all time?
You no fit force everybody to support your favorite, anybodi wey choose Messi no mean say e dey disrespect Ronaldo, e get people wey dey wey prefer Ronaldinho over Messi and Ronaldo, as you choose to support Ronaldo nobody vex for you so allow others to get favorite because everybody get reason why e dey watch or play football.
I see as most people dey even compare Madueke to Okocha because of trophies, lol, fear no go even allow Madueke tok am.
Back then, players dey play football to enjoy di game,Okocha just won enjoy di game na recently football come over serious.