Chelsea Pidgin and Transfer news

Chelsea Pidgin and Transfer news

Share

All CHELSEA RELATED NEWS

11/07/2025

Arsenal don agree deal pass £50m to sign Noni Madueke from Chelsea ❀️🀍

Package include add-ons, and Chelsea don give green light β€” everything don set!

Madueke self don already agree 5-year deal with Arsenal since, and now e dey ready to join.
Mikel Arteta really want am. πŸ”₯πŸ”΄βšͺ

Arsenal do this one for us πŸ˜‚

06/07/2025

🚨❀️🀍 Tori be say Arsenal wan drop first bid for Noni Madueke after dem don reach agreement with am on personal terms.

Madueke don agree to 5-year deal wey go reach June 2030, and him camp don greenlight everything.

Transfer loading... πŸ“πŸ”œ

06/07/2025

🚨Dortmund Sporting Director, Sebastian Kehl, don talk about Carney Chukwuemeka matter:

"Carney loan don end today as we agree with Chelsea. Now we go see how e go be. We go still run some more talks for the next few days.

"To loan player dey easier pass to buy, especially for Carney price level. Talks never too far like that, but I fit tell you say we dey close to the player and e love Dortmund well well, so na good sign.

Anything wey remain na between Chelsea and us. E no go happen on Monday or Tuesday. E go still take small time."

β€” (via )

06/07/2025

🚨Palmer, Cucurella and Neto all enter Sofascore Team of the Quarter Finals!

Chelsea get the highest number of players for the XI.
Na we run am! πŸ”΅πŸ”₯

β€” (via Sofascore)

06/07/2025

🚨 Tori don comot say Noni Madueke wan japa from Chelsea.

We hear say wahala bin dey between am, coach Enzo Maresca, and some players after that Newcastle loss last season.

Dem say e no dey put enough work for training, and Maresca no happy with him attitude. Noni sef dey vex say dem dey sub am early for match wey e believe say e dey play well, plus e wan dey play strictly for right wing.

As e be like this, Chelsea no get wahala to let am go. Noni even change agent for June, and before CWC, the new agent tell Chelsea board say dem wan comot.

Our source dey talk say Arsenal fit sign am soon, and Chelsea dey plan replace am well.

Na during CWC all this matter burst out. But make we talk true, this one no really be Chelsea fault.

β€” via ** (Substack)

28/05/2023

Today Na our final match of the season πŸ’™

27/05/2023

The women de do us proud πŸ’™πŸ†

27/05/2023
27/05/2023

Follow Chelsea Pidgin and Transfer news.
For the latest and best transfer news from Chelsea football club.

Want your business to be the top-listed Gym/sports Facility in London?

Click here to claim your Sponsored Listing.

Location

Category

Telephone

Website

Address


Stamford Bridge
London
10001