01/10/2026
UNA ABEG MAKE UNA NO VEX 😭😂
If you no see my comment for your post today, abeg no be say I wicked o!
My eye don turn!
Since morning na so so:
"Happy Independence!"
"Happy New Month!"
"Nigeria @ 65!"
"My brother birthday today!"
Post full everywhere! My phone don hang! My data don dey cry! 😂
I don type "Happy Independence" tire, my keyboard don dey ask me "Oga you wan type am again?"
If I miss your post, abeg manage me. Na celebration too much cause am. Birthday, Independence, New Month all jam for one day!
But as e be, Happy Independence Day o! 🇳🇬 Make we chop rice!