PidginNews Nigeria

PidginNews Nigeria

Share

News for Nigerian Pidgin Language.

Donald Trump no go gree mek dem turn Nigeria to Islam- Fani Kayode - 17/11/2016

Donald Trump no go gree mek dem turn Nigeria to Islam- Fani Kayode - ABUJA- FORMER spokesperson of ex- President Goodluck Jonathan’s campaign organisation, Chief Femi Fani- Kayode don yan sey the President- elect of the United States of America, USA, Donald Trump no go gree mek dem turn Naija islam country. Bros Fani- Kayode bin call Trump for phone to show say him h...

Na Ten days we yuz count the N1.22bn Obanikoro give Fayose– Banker - 15/11/2016

Na Ten days we yuz count the N1.22bn Obanikoro give Fayose– Banker - Mata wey dey hapun for kontri now be say one person wey dey work for Zenith Bank, Akure Branch in Ondo State, Sunday Alade, on Monday tell  the Federal High Court in Abuja how him and him colleague for bank tek count the sum of N1.22bn cash wey dem give the aides of the Ekiti State Governor, Ayodele...

Eagles be like 94 Team- Babayaro - 15/11/2016

Eagles be like 94 Team- Babayaro - Former Nigeria international Celestine Babayaro don salute the Super Eagles boys and the way dem tek play futbol under new manager Gernot Rohr. Babayaro tok sey that one mek am remember the Naija team wey play for USA 94. Since Naija employ new c as coach, dem don win all their matches, statin from…

Charles Okocha dey teach im pikin new swag - 15/11/2016

Charles Okocha dey teach im pikin new swag - Tori wey dey hapun now be sey Nollywood actor, Charles Okocha and im pikin dey do father and son things. The bros no wan yan plenti talk but im yuz pishure dey show wetin dey in mind for im pikin. Mek you see the pishure for here Share on: WhatsApp Tweet Share 0 Reddit +1 Pocket LinkedIn 0

Pesin waka from - 31/10/2016

Pesin waka from - Tori wey dey hapun now be sey one 26-year-old man, Tunde Agbaje, yuz  leg waka from  has Ketu area of Lagos State to Zaria, Kaduna State. As PUNCH Metro tek put am Agbaje, who be the cousin of  former People’s Democratic Party gubernatorial candidate in Lagos State, Jimi Agbaje, enta into that kind…

"My Head Oh, My Belle ooo" The new single from Macky, na the hapunin song now - 27/10/2016

"My Head Oh, My Belle ooo" The new single from Macky, na the hapunin song now - The new song wey dey rain for kontri now, na the New banging single “My head” from Macky Dee. E be like say the bobo don dey find im formula small small for kontri Naija, as e be sey plenty pipo don dey listen to im song for Naija. Macky Dee, real name na David Sunday Dania; him na Hiphop, R$B and H...

Fuel finish for my jet- man wey dey fly from Benin to UK - 27/10/2016

Fuel finish for my jet- man wey dey fly from Benin to UK - Sapele—Yawa gas for one witch doctor head wen im power to fly for night fail am. The witch doctor tell media pipo sey im been dey fly from Benin Airport, Edo State, to attend one  meeting wey im members get for United Kingdom and to yuz that opportunity watch futbol match. As the witch doctor tek pu...

James Packer don abandon Mariah Carey - 27/10/2016

James Packer don abandon Mariah Carey - Billionaire businessman, James Packer don end im engagement with singer Mariah Carey. As Woman Day tek put am, a family friend tell the magazine sey the bobo end the relationship bicos sey the babe too dey spend and waste money any how, plus on top sey dem two family no agree for the new reality TV…

Naija Polis don recover 19 Motor, SUVs from former IG, Solomon Arase - 24/10/2016

Naija Polis don recover 19 Motor, SUVs from former IG, Solomon Arase - Inspector General of Police, Ibrahim Idris, don recover 19 police vehicles from former IG, Solomon Arase. As  Sahara Reporters tek put am, some of the motor include assorted sedans, Sports Utility Vehicles and pick-up vans. The Inspector-General of Police had ordered an investigation into the purcha...

Train Derail for Cameroon, 55 pipo die - 22/10/2016

Train Derail for Cameroon, 55 pipo die - Fifty-five pipo dey for Cameroon and oda 600 pipo wunjo dem sef, bicos of one stubborn Train wey jump commot for  im road, for Friday.   The train, been dey travel from the capital Yaounde to the economic hub Douala, wit plenti pipo inside am, transport minister, Edgar Alain Mebe Ngo’o yan.   The mi...

My wife job na for my kitchen e dey - 15/10/2016

My wife job na for my kitchen e dey - Presido Muhammadu Buhari, for Friday yan sey him wife job na for im kitchen and no be to do politis. Him tok sey Aisha, no get any right to sey anytin about im leadership. The Presido sey, “I don’t know which party my wife belongs to, but she belongs to my kitchen and my living room and the other ro...

Boko Haram don mek Naija and France become Padi padi- Denys Gauer - 14/10/2016

Boko Haram don mek Naija and France become Padi padi- Denys Gauer - The Ambassado for Europe, Denys Gauer, tok sey Boko Haram mata don mek Naija and  France become padi padi, pass as dem be bifor. Him yan this tori for queen english wen im visit Sokoto Govanor, Tambuwal, Aminu.   “We were good friends in the past, but the outbreak of the Boko Haram conflict has brou...

Want your business to be the top-listed Gym/sports Facility in Alagbado?

Click here to claim your Sponsored Listing.

Location

Telephone

Website

Address


12 TEMIDIRE STREET COCA COLA BUS STOP AIT Road
Alagbado

Opening Hours

Monday 09:00 - 17:00
18:00 - 19:00
Tuesday 09:00 - 17:00
Wednesday 09:00 - 17:00
18:00 - 19:00
Thursday 09:00 - 17:00
18:00 - 19:00
Friday 09:00 - 17:00
18:00 - 19:00
Saturday 09:00 - 17:00
18:00 - 19:00
Sunday 09:00 - 17:00
18:00 - 19:00