AZ football Academy

Call Directions Contact the business

AZ football Academy We are a football Academy club based in port harcourt, Rivers State, we train and manage players.

A very big Thank you to His Majesty, King Edward Asimini William Dappa Pepple III, Perekule XI, Amanyanabo and Natural R...
26/06/2026

A very big Thank you to His Majesty, King Edward Asimini William Dappa Pepple III, Perekule XI, Amanyanabo and Natural Ruler of the Ancient Bonny Kingdom for your financial support to our dear academy after our impressive outing at JESUS tournament that took place at sharks Stadium Port Harcourt.

To our big Boss that gave us this great opportunity to showcase our God given talent, the Secretary to Rivers State Government Dr. Dagogo S. A. Wokoma we say thank you 🙏

Together we shall build a healthy society.

08/06/2026

Law in pidgin, I fit sue person wey betray me?

Wetin law talk?

Almost everybody for this life don sofer betraya|| whether small one or big one.

Sometimes, this betraya| dey come from people wey you know well well and people wey you and them dey chop from one plate.

When e happen, you go just dey helpless and confuse whether you go go Court, Police or forgive and forget.

🪡 The truth be say if person betray you, nothing you go fit do.

🪡 Betrayal no be 0ffence for law. No be even civil wrong.

But, calm down

🥢Betrayal fit land you go chop free beans for Federal Government free housing estate, e fit even land you for big law suit.

🥢Sometimes, you fit carry your friend go your b0yfriend house and she go from back go mekwata your b0yfriend. This one dey happen well well. The truth be say, she no commit any 0ffence or civil wrong.

🥢But if as she dey go snat,ch your b0yfriend she come leave mekwata wey she go do begin tell the man say you be tief or say you get golo, na their law of defamation go hold am. 👈

🪡 So, as you dey bet+ray people, no commit civil wrong or cri!me inside.

🪡 If your betr-;ayal carry 419, defam,ati0n, f0rce mekwata, ass"'ault, Moda, etc, then you go go chop free beans.

🪡 If your betr*"ayal carry civil wrong like ass!! ault, battery, false imprisonment, negligence, then civil law go hold you.

Welcome to law in pidgin school.

21/04/2026

Read to avoid pris0n for cr!me wey you no commit👇

When you buy new motor, you rush carry am go church make pastor bless am. You rush go shri!!ne go show your motor to ju ju priest. I no know whether Muslims too dey carry motor wey them buy go show Imam make e bless am.

But you go forget the real and important legal things to do to avoid free hot beans for Kuje or kirikiri.

Now, when you buy motor wey person don dey already use for Nigeria, do these things:

🪡 Proof of ownership certificate
🪡Change the plate number (number plate)
🪡General Motor Receipt
🪡 National Certificate of Roadworthiness
🪡 Computerized Vehicle Inspection Referral Notes
🪡Vehicle Insurance
🪡 Motor Vehicle (Third Party Insurance)

Now, if you read all the car papers, you go see say e carry your name and your address.

You know why you need to do these things fast before you even tell people say you don buy motor?

🥢the person you buy am from fit don commit cr!me with the motor wey Police dey find am. And them fit see you with the motor, and them go arr:est you.
🥢the person fit still come claim say na him be the owner because the motor still carry him name.
🥢him fit don use am go collect loan before e sell am to you.

Before you celebrate that second hand motor, do the legal documents or papers first. You fit happy finish now, and the next 24 hours, you dey Kirikiri.

To do papers no hard. 👈 Go Federal Road Safety Office or you go Inland Revenue and you go do all your papers.

Make wetin suppose bring you joy no bring you p8in.

Welcome to law in pidgin school. ❗

15/04/2026

Mouth to mouth (oral agreement) 👇

Court dey respect oral agreement. In fact, we get oral and written agreement. Court dey give them the say respect.

But if you need 20% energy to prove agreement wey una write for paper, you go need 100% energy to prove am if na mouth to mouth agreement.

This na why you need to run from any agreement wey them no write down 👇

🪡 how to prove quantity.
🪡 how to prove quality.
🪡how to prove time and place.

To avoid this wahala, write am down for paper and make everybody sign.

Na who get evidence dey win case.

🏃💨 from oral agreement. Run❗

04/02/2026

Women as Surety for Court or Police station 👇

LAW IN PIDGIN, my brother get case where him go tief panttt and brra for person compound. Them catch am come a+rrest am, house
arr; est. Them say Police go come carry am. I ask am why, him say na devul push am. Now the only dey claim say my brother dey do yah0 00

Them go carry am go Court. Na only me and am our mama born. We no get another boy.

My neighbor tell me to begin find who go bail am stand surety for am because Police and Court no go gree make I stand as him surety.

I know say wetin my brother do no good. I no fit abandon am. But I wan know wetin law talk 👇

Me: your brother dey into something 👈

Oya Check comment make you hear wetin law talk 👇

Address

Rivers State

Telephone

+2348032771423

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when AZ football Academy posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to AZ football Academy:

Shortcuts

Share

Category