12/12/2023
π₯ 50 Goals from the Gaot π
CR7 for a reason.
Na the match against Al shabab yesterday wey him take score e 50th Goals π€―
Abeg like this picture, no be every body goat don achieve am at age 38 π
11/27/2023
π Last last honesty dey for football, na just some players wey no go want talk true...
If u watch the match today, comment wetin make Ronaldo dey wave hand...
11/27/2023
π₯ After that Man United vs Everton Match on Sunday, people online don start to compare Alejandro Gernacho bicycle kick goal to other players own, like our own CR7, Rooney and Bale.
Dem dey argue which one be the best.
πͺ One thing for sure, na CR7 Bicycle Kick goal get the highest jump height of 2m.38cm. No other one reach am. Na wetin still keep Ronaldo bicycle kick goal for the top.ππ
But wetin you think ? Which bicycle kick be the best π€
11/19/2023
πππ take am easy ooo, no too laugh I no dey
11/19/2023
π₯If him no score, him go assist π₯ Cristiano Ronaldo β½
Our Goat π no dey fall hands, if goal no show, assist go show πͺπ€©
Unlike some other Go__ wey I know ππ
My people see the small stats π
βΌοΈFT Portugal 2 - 0 Iceland
βΌοΈBruno Fernandes be the man of the match with 8.9β rating from fotmob
βΌοΈBruno Fernandes β½ 37' Bernardo Silva give the assist π
βΌοΈRicardo Horta β½ 66' Christiano Ronaldo give the assist π
Make una dey try dey choose una Goat wisely ooo π
11/19/2023
π₯ see the list of the top 10 players with the most assist for there national team.
The prince of football, Neymar na em dey lead this one ooo...
Followed by Messi, Ronaldo 4th.
11/19/2023
π₯ inside first half na em lukaku take nak people father, and people husband 4-0 π€£π
Omo my people the [ Belgium 5 - 0 Azerbaijan ] match don end ooo. β½
Lukaku score hatrick, still add am one goal on top inside first half ooo π
And Dem dey talk say lukaku na flop player π
E be like say na the anger him take play Azerbaijan today ooo π
Lukaku 17' 26' 30' 37 β½
Trossard 90' β½
How una take see d game abeg π
11/18/2023
π₯ oya ooo my people CAF (confederation of Africa Football) want give award for the top player of the year! π
π₯ The award go happen for Palais des CongrΓ¨s, Movenpick, Marrakech, Morocco. On December 11 2023
See the top 10 players wey make the list, there names, country and club π
1. Riyad Mahrez (Algeria, Al Ahli) π©πΏ
2. Andre-Frank Zambo Anguissa (Cameroon, SSC Napoli)bπ¨π²
3. Vincent Aboubacar (Cameroon, Besiktas) π¨π²
4. Mohamed Salah (Egypt, Liverpool) πͺπ¬
5. Achraf Hakimi (Morocco, Paris Saint-Germain) π²π¦
6. Sofyan Amrabat (Morocco, Manchester United) π²π¦
7. Yassine Bounou (Morocco, Al Hilal) π²π¦
8. Youssef En-Nesyri (Morocco, Sevilla) π²π¦
9. Victor Osimhen (Nigeria, SSC Napoli) π³π¬
10. Sadio Mane (Senegal, Al Nassr) πΈπ³
β₯οΈ Winners go dey decide based on votes from CAF Technical Committee, media people, head coaches, and captains from member associations and clubs wey involve for the group stages of the interclub competitions.
So long story short, na vote go decide the winner π
Comment below who u feel like say supposed carry this award π
11/17/2023
ππ₯ our very own CR7 don come true for us again ooo
Goat π doings... no competition.
before I go forget... π
The match don end ooo with Liechtenstein 0 - 2 Portugal!
Man of the match na Joao Cancelo with 9.3β rating from fotmob
Ist Goal β½ na Christiano Ronaldo for 47'
2nd Goal β½ na Joao Cancelo for 57'
Your Goat score today ? π
11/17/2023
π₯ my people the Argentina vs Uruguay match don end ooo, with unexpected results.
The match end with Argentina 0 - 2 Uruguay!
Man of the match na Darwin Nunez from Uruguay with 8.0β from fotmob.
The two goals happen for 41' β½ Ronald Aruajo and 87' β½ Darwin Nunez!
First Argentina defeat since when Dem win the world cup ? π€
11/15/2023
π³π¬π³π¬Naija queens dey shine ooo ππ! Asisat Oshoala, wey dey Ballon d'Or nominee level, plus Rasheedat Ajibade and five other fire babes don land nomination for di 2023 Confederation of African Football Women's Player of the Year award. Dem release di list on Tuesday, and guess wetin? Naija get di highest number of nominees - we dey lead!πͺ
Abeg, mark December 11 for your calendar because na dat day di 2023 CAF awards go burst for Marrakech, Morocco.
Our Naija babes wey dey run for awards include Uchenna Kanu, Chiamaka Nnadozie, Osinachi Ohale, Toni Payne, and Christy Ucheibe.
But hold up, e no finish! Our Super Falcons' head coach, Randy Waldrum, dey di mix for coach of the year.
No forget di young stars wey dey burst brain: Deborah Abiodun, Esther Ajakaye, and Oluwatosin Demehin dey run for Best Young Player of the Year. Na football paro, and Naija dey carry go! ππππ³π¬
11/15/2023
RIP β₯οΈ
Former international goalkeeper George Chigova don pass away at 32. The "Zikeeper" collapsed for im house for South Africa afta e suffer heart attack for July. π’
Chigova bin get 32 caps for Zimbabwe, play for Africa Cup of Nations, and win di COSAFA Cup for 2017 and 2018, etc.
News : Him die afta e just fall for e house for South Africa.